Monday, December 7, 2015

How Close Spouses Suppose dey before Marriage (Appropriate Level of Intimacy before Marriage)?



One day I hear one woman dey yan about wetin young girls suppose do to make man marry dem, she dey provoke dey talk say how them go take know say them go born pikin if the girl nor get belle for the boy before marriage? Say, How man go take marry you if una no 'do'? I just sidon dey listen as Olofofo concern, I try to understand her view point, but I know say as a Christian, E no good.

To even reach dat level of getting belle, you don cast sef, according to my belief as a christian, because you no suppose reach dat level of INTIMACY with the guy. I sure say other religions even support wetin I dey yan sef.

So, which LEVEL of INTIMACY you suppose reach to draw the boundary ???




My People, make una drop comments for here, so that we go fit see your views.

To see more tori, click here

No comments:

Post a Comment

Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views