Saturday, July 19, 2014

Warri Bible: Day 7



John 2:12-18

After dat miracle, Jesus come fall-in Capernaum with E maleh, bros' and disciples, but na few days dem Lodge for dere.

Now, The Jewish Passover don dey near, so Jesus enter Jerusalem. For dere ,He see say inside the temple, people dey market 'Nama', sheep and dove, people wey dey change money sidon there too sef.

Jesus come provoke, use rope take make 'koboko', pursue dem comot for the temple–both the sheep and the 'Nama–scatter everything, throway their coins. Then to those wen dey sell the doves , He come say, 'comot all dese tins from here! Make una nor dey use my Papa house as una market place.'


For updates on this series, please keep a date with us, same time, same place,tomorrow. For suggestions, comments, and advert placement, contact ogeh.akpevwe@gmail.com, 08061126972

No comments:

Post a Comment

Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views