Friday, August 28, 2015

SHOT IN THE CRIME!!! ROBBERS KILLED BY POLICE IN PORT HARCOURT (PICS)


Pikin wey say e mama nor go sleep, no go see sleep!!! na wetin happen to these two dare-devil armed robbers as dem dey rob punch office for Mile one, Diobu, Port-Harcourt, Rivers state.
 Na four robbers nai enter their circulation office, come force the manager, one Mr Raji Tajudeen collect N500k from the man.
The manager just come back from bank some minutes before the robbers track am, collect the dough.
Before dem run reach the main gate, the manager hala, men for area come gada, nai dem throway bullet for air, thinking say everybody go disconnect. 
 Based on say Niger-Delta no dey wan take ear hear thief matter, and dem come even shoot, everybody para follow dem, come chase all of dem enter one house for Abakaliki street for mile one. Na there gallant kpor-kpor(police) cor show, fall two of the Robbers, while two escape wit bullet wounds.
Police later refund N250k as the dough when dem recover from the boys wen carry out the hit so,the manager still even shake based on say e dey suspect say informant dey the parole.

Rivers State police command PPRO Mr Ahmad confirm the story as he cor dey hail the gallant squad wen fall the two robbers.
Ahmad Still dey advise everybody to dey reduce as dem dey run matter with raw benjamins since e-transactions nai dey safer.
See more tori here

No comments:

Post a Comment

Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views