Thursday, November 27, 2014

Warri Bible's 'speaking in tongue series'

1 Corinthians 14

20. Brodas and Sistas, make una nor dey reason like small children; continue to reason like dat sha wen e be bad things, but for back of your mind reason like matured person.

21. Dem don write am down before before for book like Isaiah(Isaiah book form part of the Law) say God say, 'thru men wen dey spirifit foreign langua wey person no dey understand and thru d mouth of foreign people I go yan give dis my people, and dem no go listen to even me sef.

22. So e mean say, spiritual tongues na for sign, no be for born again christians o, but na for those wen never believe, and prophecy nor be for unbelievers but na for believers.

23. So, if d full shosh gada and everybody dey kabash, and people wen neva dey kabash, or believe, or even know wetin dey happen con enter, dem nor go talk say all of una dey kolo?

24. But if everybody dey prophesy and unbeliever or outsider wen neva learn about kabashing fall in, thru d prophecy e con clear for e eye say e dey into sin,

25. All d secret wey dey e heart, he go dey even hear dem sef from d prophecy; so, e go lie down face ground, worship Baba God, come dey say God real real dey among una.

I hope you understand the mind of God from this post, I did and I can't wait for you to hit that comment button and leave a comment.

No comments:

Post a Comment

Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views