Area! no matter the size of Ibeke, e can never be tribal mark, if you like make you get hot temper, e no go fit boil egg, any body wey say your yam no go don, dem no go sell stove for their market.
Today, I attend one meeting, and one bros come dey complain bitterly, say as a contractor, e never do any reasonable job since buhari enter the setting. September don reach, Children go soon go back toschool, and hope no dey for anywhere.
My mind come run go 1983, when Buhari first rule us, I know say dat time dem never born some of una, dat na by the way. As I dey yan before, 1983, things hard when Presido enter dat year, everything tight like mini skirt. Even the 'Burgeoise'(I no know if I spell am correct, but if you no like am, go spell your own), hear am hot. I go show una wetin countrystudies (see full article here) talk;
"The government introduced a comprehensive
package of austerity measures. It closed the country's land borders for
a period to identify and expel illegal alien workers and placed severe
restrictions on imports and heavy penalties on smuggling and foreign
exchange offenses. The austerity measures made it difficult for local
industries to procure essential imported raw materials, leading many of
them to close or to operate at greatly reduced capacity. Many workers
were laid off, and government itself retrenched many workers to increase
its "cost effectiveness." All of these actions were
accompanied by high inflation. The price of basic food items rose, and
life became increasingly difficult, even for the affluent."
Ghen Ghen!!! I no know how e go be for us o, but as a sharp warri boy, na to dey hustle the small way when I fit, but make una no worry, e go better one day nai Ette take tay for Lagos. Person wen dey cry still dey see road
My people, I nor know how una see this matter, but if you get comment, encouragement, make you clear us, because some people liver don dey cut dem like dis, but me as a Warri boy, nor dey fear anythin, no shaking! one love.
see more tori here
No comments:
Post a Comment
Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views