Thursday, October 9, 2014

The Holy Bible entirely in Warri Pidgin English, 'speaking in tongue' series





Dear friends and readers, its back,its fresh and its getting spiritually interesting..Its our very own down to earth dissection of the Holy scriptures in our very own lingo,PIDGIN English.I am sorry for the Lacuna, but its for the best, your responses are awesome and the request for the continuation of this series filled up my mail,so I will drop it while its hot.

  Our reading today is culled from 1 Cor 14:7-13


"Even for the case of lifeless things wey dey bring sound, like  pipe(wind instrument) dem, or harp( string instrument), how anybody go take know which tune u dey play unless difference dey for the notes? 

8 Reason am Again, if trumpet nor sound clear to alert people, who go ready for gbeghe(battle)?  

9 Na so e be for your side. Unless you yan reasonably with your tongue so, make your shosh members dey understand, how anybody wan take  know wetin you dey yan? You go jus dey yan dust. 
 

10  No reason am o, many languages dey the world o, still on still, all of dem get meaning.  

11  If I nor understand the meaning of  wetin somebody dey yan, then I be stranger to who dey yan, and the person wey dey yan,na stranger to me. 

12 Na so e be with you. Since you dey urge for gifts of the Spirit, try to dey master the ones wey go build up the shosh. 

13 Based on this things, make anybody wey kabash, dey  pray say make somebody fit interpret wetin dem kabash for inside the shosh (church)."

I cant wait for you to leave your comments and click that subscribe button.
Click here to view more posts.


2 comments:

  1. Plenti grama still dey for dis Bibul o. Make una invite Vwaire Ofigo from Crown FM make him yan the Warri pidgin well well!

    ReplyDelete

Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views