Sunday, August 23, 2015

WARRI BIBLE 'SPEAKING IN TONGUES Series-6'


Area!!! God don do am again, Ose Migwor!!! ,I don wake up,their dad! (dancing) Okpolor no be open eye, no matter the size of ibeke(scurvy) e can never be tribal mark. Today na another super sunday for me o, I no know about you, but e good make you happy well well today because God don make you see another day.

Okay, make I tell you one thing wey you go do as you wake up so, just stretchhhh, make you check how you feel, you dey kakaraka(strong) and healthy, by now sef some of una dey shosh dey praise Baba God, as for me, I dey look for the oda leg of my shoe since morning, I never see am, I just take am say maybe Baba God want make I just minister thru this blog today as I no go shosh, abeg no mind me, my own dey my body sometimes.

If you are feeling the Warri langua, say 'yea, yea'!

My people e don tay when we read bible for here last,
(prayer): Baba God! any witches and Lizard when say we no go dey follow up our waffi bible, Holy GOSSSS!!!!! FIRE!!! .

Yes! dem go know say we don ready.

 Today we go talk about how Church/fellowship suppose dey hold meetings when go help everybody based on say d brethren don dey kabash steady, I no wan add anything o, I go jus talk am the way Broda Paul talk am for 1 Cor. 14: 26-28 in Warri Langua;

"26. So, Brodas and Sistas, wetin una suppose do? when una meet for fellowship, one person fit get song to sing, anoda one wan preach, anoda wan prophesy, anoda one dey kabash for one side and somebody dey interpret d kabashing, all wetin dey happen so, suppose benefit everybody so dat their faith go strong.

27. When una meet, not more dan two/three people suppose kabash for inside d shosh so, and all of dem cannot dey run am d same time, na one after anoda, and one broda or sister as interpreter suppose dey.

28. But If interpreter no dey, make dem quietly dey kabash give themself and to Baba God."

Okay, na so Broda Paul yan, but if you say you get how you wan take explain am, abeg just hit the comment button make you yan your mind as Holy Spirit take explain am for your conscience.

I remain the one and only warri boy when sabi run am, the way you like am, but if you no like am, abeg go down low.
Peace.

see former posts


No comments:

Post a Comment

Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views