Monday, August 24, 2015

WARRI BIBLE 'PROPHESYING Series-1'

Area!! My People, I don miss una, abeg make una no vex, as oyibo people dey yan, 'circumstances beyond my control took me away from you all for a while', but I wan drop the word for today inside this series. We go continue from where we stop on sunday we go see wetin Broda Paul yan concerning the way people dey operate under the Holy Ghost for shosh. Oya straight to the matter.

Before I open the powerful word of God, oya make we pray...'Baba God wey dey for heaven, make we understand your mind as we dey reason your word in Jesus' name, Amen.

Okay, 1 Corinthians 14: 29-33

"29- Only two or three church members suppose prophesy for the meeting, evri oda member na to quiet, listen and reason wetin dem yan.
30- If God send one message to one member wey sidon dey listen as one person dey prophesy, the first person wen dey prophesy go quiet e mouth.
31- All the two or three members fit prophesy, but make dem run am one after the oda, so everybodi fit learn and make dem spirit fit rise from encouragement.
32- The Prophet suppose fit control the spirit of prophesying.
33. Baba God nor be confusionist, but na God of peace.Wetin I talk so nai suppose control all d meetings when God children gada hold."

Okay, so na so we take wrap up the matter for today, we go see tomorrow, no forget to leave your comment for the 'comments' section.
see more tori for here


No comments:

Post a Comment

Disclaimer: All comments are strictly users viewpoints and do not represent in anyway, the warri boy's views